This one no bad because it will make us to know who dey come here but na interest and not a compulsory thing to do dat. But e good for our Naija users to report themselves here.
I no see how introducing yourself for the first time wey you come this local board to post be bad thing because if you go new area wey you won take part of wetin dem dey do, you need to introduce yourself. For school, we dey tell people our name for tge first time when we enter class because na our class be dat. Talkmore of this big forum wey almost every country don know say Nigeria no get any local language wey we dey use pass English and pidgin. The pidgin self na only 35% of people dey use am. English na our major language and how we go come know say you be Nigeria when you know introduce yourself. However, everybody fit do wetin e like and if you no introduce yourself still no issue.
Well, I believe say everybody get their own ways as here na place where person get freedom. E dey left for anybody wey think say e dey right or wrong for am to introduce him or herself to the local board members to know am. The thing be say, we all dey here for bitcoin education and this platform avail us the opportunity to meet and know ourselves from same country. However, if person no want to do the needful that one no be issues, life goes on other people wey go like to introduce themselves dey we go welcome them thats all and every man to his own fate.