The whole mining Hashrates process been based on KYC level and me only run Tie 2 KYC as if that time wey that mining begin, I been dey among the first set of miners but as time goes on to dey log in Remtano come dey mine tire me so I left it like that.
Na only 4 RENEC I mined that period and it's worth nothing more than N1500 at the moment.

Even me too all this mining dey quick dey tire me, sometimes the Kyc process is some how stressful and to dey wait till dey list am nah another Wahala. But how most pipo dey cash out for this mining stuff Omo mi mind don dey. Dey Ooh like one of my guy bro just focus on this mining stuff and e dey cash out put. But may be if another still dey I go try mine make I look how e go, go Una don still boost my confidence small.
No be only you my brother, honestly, the mining no dey easy, atleast, for people wey dey busy, my own no be even matter of kyc, because my strategy be say, immediately I begin mine, I know say by the ending, they go still require miners to pass kyc verification as that na only way they fit take terminate all the double accounts them, so, wetin I dey do be say, that time wey the kyc never dey hot, I go quietly and jejely verify my account, because if you wait till they begin tell people to verify their account to claim their token, the traffic dey always make the verification process hideous and stressful, but if you do am that time when no body dey talk about kyc, e go be stress free.
My own major problem with all this be say, most times, I dey forget, I fit stay like 3 or 4 days without mining, sometimes a week self before I go remember to mine.
And truth be say, boys Don make better money from all this mining stuff, somebody for my area here made over 20 million naira from Avive wey recently launched, I no won talk about Renec own because that one be here, even though all this tokens dey later significantly drop in their price, the truth be say, that time wey dey launch, they dey make some really lucky fellow overnight millionaires.