Country men. No worry we don show for the alma matter here. Very soon we go dey shake the ama with our swags. You know say Naija no dey take last for their mata so no expect us to settle for less.
Very soon more Naija big names go join us for this matter as e dey go so. Una don try for the move una don make for here. I don see as Naija board don get child boards wey go make things very easy to do here. Una weldone o.
Even my oga don reach here and he even wear signature ❤️ congrats big name and I believe say togther we go also gain ground for here but truth be told that, this other forum Dey more complicated than we’re we Dey come from but normally, nothing Dey just happen because it must start from somewhere and with all this stuffs been said, @op try make you stay active as you don take the responsibility upon yourself, I believe say no be easy task but brotherman I assure you say e go definitely pay off when the time come.
Chief I greet you too. We dey here together o. Make we run the town together like nothing happen. E dey sweet me say country people dey quick to show up here. One thing I go like make we for do be say make we wey don already show up here try our best to make sure say own very own board dey much active here so that others wey come go see am den dey encouraged to dey active because Na we wey don already land here go make way for others to come see for themselves how things dey happen here. Na so dem too go tell others
As for the platform, I believe say the platform go dey easy to navigate as time goes on since e be say we never dey used to am and also, more development and update go dey take place as the traffic dey increase.
You are right dear brother, I completely agree with, for me Sha, I don tey wey I don join this forum, only thing be say, as nothing much been dey happen for here, e make me no too dey active like that, but with the current development on the forum, I believe say things go dey different from now on and going forward.
So, for me, wetin I fit talk or advice now be say, as we don dey here, make we try use this medium to share very important information wey fit benefit us all, not just to dey discuss things wey no make any sense, or dey relevant to our being in crypto, they dey talk say information na power, so, once again, make we all try to use this medium to share only things wey go benefit us all.
Meanwhile, good luck to every one of us and happy holidays and seasons greetings..