Good afternoon everybody, I greet una double double.
I just dey teleport my account here today as na just now I dey get the update from my gee, so I hope sey everywhere sacracum the wey I hear ram before I signed up.
How far guy, wetin sup na? Seems to me say na new sign upee you be, why you come talk say you teleport your account? Which account and from which forum you teleport come here abeg, me for like to know.
And unfortunately, e come be like say you no read the forum rules as you join, because going by wetin I dey see, admin dem don hammer you with plagiarism strike, you for know say to dey copy paste and post other people posts as your own, without any reference to the original post or person wey you copy am from na serious offence..
Anyways, I wish you learnt your lesson, and won't be making the same mistake again if admin dem fit give you second chance.
I hope you see this anyway.