Rumour wey dey currently be say petroleum product stakeholders and traders don dey peg petrol price to 1.2k naira per liter. Omor, e reach to shout because once we reach that point of sale of petrol at that price, na just a step further into more hardship, food and transport crisis too. For naija wey be say once price go up, then no hope for coming down again.
Currently, see transportation cost wey don dey drive reach 40k from the west to east, imagine the cost when petrol price reach that rumoured amount. There'll definitely be hike in everything, even cost of food because to transport the food sef go dey expensive. Now of all the promises made, which one has been kept. We just dey in a jeopardize state, we can't do anything else beyond lamenting for, dreaming and imagining a better naija sha.