Well, e don tey wey i use my Binance run p2p mata, but i fit still remember some kind things. From watin u just talk so, i doubt if Binance go fit just delist kuda as payment method. The person wey wan buy the usdt dey usually specify were e wan pay to, but they dey sometimes accept all of them. I no remember de last time i use my bank acc to receive money because most buyers dey accept opay even wen dem no state am.
In regards to the change of account details, e fit b say something don happen behind the scene. Inorder to be on a safer side, open new account with other app, make sure say u use de same name wey u take register ur Binance, then update am. Try dey check am all the time and before every transaction.