I day greet all of una wey go don see this post for the platform, most time e get as body go do you wey you go just to contemplate on watin you wan post, this na the ogbonga way, wey I dey take do my own o, do I say make I shear am with una so that, if at all sef person fit tell person wey know person to shear idea among our selfs for this forum.
Most time when some ideas just enter your head, you fit just write am down then try to get more concrete information about am so that once you post am for the forum e go educate people and also people go get the quality and ogboga gist o, because them say information is power.
When I talk say make you get better and concrete Information, e no mean say make you go do copy and paste o because that one na plagiarism and e day very wrong, and also as the forum dey against am them fit report your post o, so make we try get better better information them about something before we dey shear our information o.
Una well done o ...