I think say na on the 8th of July nai dem tok say dem go launched the p2p for Nigerians again and then started the VAT from that day but I no come see them again. I don check tire. Abi na me no get the information well. But I think say na weti I see for the email. Well whenever dem reopen it we go use am buy that vat wey dem dey tok go make plenty people no go use am again oh.
8th July na the date wey dem talk say that VAT go begin, them no talk for any of those email say p2p go resume for their platform. If you hear anything about p2p, na just people dey carry the matter waka for mouth around based on say if dem go dey collect percentage from them, them no go limit them to do some kind things with their services. No any news on p2p back on the platform, but make we dey wait sha, maybe something like that go come back soon again for the platform.
Me no even dey after make p2p return back to the platform, as far as we have bybit, I am very OK, except anything go happen way fit make bybit close their doors to naira p2p, then definitely will be a problem.
But still, yawah no dey self, we go still look for another place, even telegram wallet get naira p2p inside the wallet, of which I Don use that p2p service for like three or four times now, the only downside for there be say the rates never too dey good, and they dey sometimes delay to pay as well - as in vendors dey always wait until the last minute before they pay, but I know say that one, including the not so good rates, na because p2p liquidity never enter there, once that enter, every thing go dey OK and even more convenient than those cex.