Omor, na why to gain technical knowledge sef dey good. Make person no just dey make use of something without knowing how to protect emself or keep im asset safe. Imagine say one of us na victim to that kind tin, e no go easy at all, na all this kind tins dey make people to talk say crypto na scam because, the routes to use take scam people just too many, and if you no dey careful, one day e fit reach your turn. E don tay wey I dey crave to learn technical deep tins on cryptocurrency, though I don take step, but e belike say I go fire am small, because this tin no be joke again. Though there are other reputable wallets wey don dey and na those among those ones I dey use, wallet like electrum, blue wallet... no be every new tin we go try, you guys should stay safe out there.