Time for protests don pass because when them supposed protest na when this current president enter seat everyone wey dey want to protest now for stand up say we no need this man and he didn't win he manipulate result to enter seat but yet everybody keep quiet because them no wan die. So this one dem wan do means wetin? Abeg na medicine after death na just noise and Tinubu no get consciences for any people if you like go kill una self till him tenor ends nothing go happened instead price of food and other things go keep increasing.
No be lie the protest for make sense immediately after the election. But anyhow we thank Jah say e just happen even as the result already dey known before protest . Even police go help wound and kill innocent people.
This na thuggery, touts go take over any centre wey the people gathered to raise their hearts felt pains as usual (permit me to say)
But come to think of it, this thugs and touts, them no be 9ja people? This one means say Wen we followers ready for good government we go take over.
Some how the failure of the people by indirectly wanting bad government start during election.....! In various polling units, to center /ward, to local government, to state before federal and finally giving inec the power over we all.
I believe another election 2027 go make more sense. Cause if dey follow up elections, you go see say 2023 election dey very different from the others.