Anyways just as I see the post I been wan pass onto say the topic and the date for the protest Dom pass but I no go pass when be say the things on things wey lead to this protest still stand gidigba for ground still carry two legs dey waka peacefully. Before this protest start for that 1st of August for my work place me I talk am say this protest no go work anything for Nigeria instead after the protest things fit come hard more for the country for us oo them say I dey talk out of knowledge especially my oga wey too sabi.
But e no sweet me say my word gain victory, e pain me say things come dey more worst than the way e been dey, prices of goods come dey very costly any how.
To be honest peaceful protest no go solve anything for Nigeria people still dey there dey chop our country money while na the common man dey panic. No be yesterday wey tinubu wife come campaign for my area wey people just dey worship her dey fill form wey Dom no go pay. Bible talk am say my people perish for lack of knowledge shebi as that woman come so everybody dey inside house no gree come out them go come drag them? Dey ur house make them know say no joy she come share 2k people happy where that one wan go Africans believe in palliative too much
October 1st protest still changed nothing but people died are there names recorded are they heroes? No, lives just wasted why can't we learn from Ghana and be one minded. If Nigerians like make we protest from now till thy kingdom come nothing will change. It takes wisdom to achieve.