I greet you all my fellow Naija people.
As we all know crypto industry no dey save again, scammers just full everywhere in the crypto industry.
Scammers no wan allow us rest na wetin dey worry me I sey make I con discuss am with my bosses here make una advise give us how we go take prevent ourself from this scammers in crypto.
First of all, anything wey dey too good to be true make you avoid am by all means. The crypto space no be place wey you go just come pack free money or you go become rich overnight, so dey careful when you see offers likes that them go come dey ask you to drop small something to be eligible. Scammers dey always come with new technique wey them dey use scam their victims, so there methods are unending and you go just dey on the lookout for current trends and make you shine your eyes wella before you engage in anything like that. Things dey happen sha wey we no fit point out all, but if you sabi them the basics wey I mention now and you dey vigilante enough, scammers go hard to take advantage of you.
Na better thing you talk my brother, and just to add to everything wey you don talk, I go talk say one wise man tell me say, for person to reduce him chances of ever being a victim to scammers; in fact, to even bring such chances down to zero self, the person gats to always read, the person need proper and latest knowledge, and knowledge comes by reading, listing, find out what is the latest trends in everything wey the person dey involved in - you Don mention this one Sha.
Reading and getting knowledge na em go help us always dey one or two steps ahead of the scammers, whereas, any type of tactics, or tricks wey them try to employ, just as way for them to try to scam us, we fit Don already know about am and we can easily jump and pass.
Another one be say make person no put money for wetin him no understand, something wey you no dey sure of, or no understand how e dey work, no let anybody pressure you put your money there, except say the person won just risk am with an amount of money wey him dey sure say him fit afford to lose.