It is now time for people to unite so that those we elect and choose can recognize our voices and value them in everything being decided regarding our future. To this we pledge our unified efforts and make a life that is safe, dignified and free from conflict a life that is capable of giving every person hopes and dreams of a life with out conflict. Only the real action that is taken implies the real change that will define our future surrendering to a better life that we need.
Wetin dey happen nw be say economic situation wey everybody dey face dey cause financial crisis wey everytin don get cost, and government no dey look into d matter well well. People try to protest, but dem efforts no dey yield result. People dey face serious problem, and dat's why we need to shine our eyes well before we choose leader, because na we be d ladder wey dem take climb reach power, but dem forget our effort and focus on dem self and family.
Na true you talk my broda, we suppose come together, nd unite, so dat we go fit achieve our goals. We need to tink well b4 we elect our leader. I suggest make we elect young people wey still get strong brain and body, wey go fit make strong decision wey go bring growth and development to our country. I think say old people wey dem elect be part of d problem wey dey affect our country, becos dem no get d strength, both physically, mentally, and socially. Dem no get d capacity to carry d responsibility, and dem thinking no dey broad. Psychologically, dem emotions no dey stable, and dem always dey think negatively, dey think say make dem gather money for dem family before dem die.