E no clear again how person wan take survive for this country. Everything don cost- food, transportation, even sachet water wey man pikin dey survive on don even join. Salary no dey increase but, prices of things dey go up on the steady like say na game we dey play.
Person go wan use work wound him/herself but yet go still dey calculate how to eat two square meals. The thing we dey pain me pass be say our people wey we dey call our leaders wey suppose help us, just dey make promises, but still things things no dey get better. E tire me gan.
I believe say I dey speak most of our mind. So make I ask, how una dey take survive for this economy? shey na side hustle or say we just dey manage, hoping for a better tomorrow.
U talk as if u no d tin wey dey 4 my mind, wahala don 2 much 4 dis country, leaders dey com nd go, nd anyone wey com na promise dem dey make, I no know wen dey go take us 2 d land of promise. Problems jxt dey increase day 2 day, na only God take know wen dey go finish ooh. na side hustle dey mak person survive 4 dis life ooo, e no easy at all. Person go dey hustle hard, nd d Moni wey dem dey earn no dey reach to spend, sometimes d country no dey gree mak person chop, no be bcos dey no wan chop ooo, na because dey no get wettin dem go chop. Our leaders no dey look dis situations oo, dem dey pretend lik say notin happen, na pure act of wickedness bi dis na. Dey don 4get say dem go face judgement. Na wow 4 dis country ooooo.