e dey very gud mak we dey very careful well well, cus somtim u go sidown dey do ur tin u go come see ads wey dem go tell u say, u go money well well for dat ads, greed go com push us mak we follow d instructions, after u don follow d instructions finish, nd u put all our information finish, dem go con tell u say mak u put money and ur money go double, if u put am, nd u see say everytin wey den talk na true, u go con put huge amount, so dat u go make huge profits, na for there two zero go catch u. U go loss all ur hard work and crypto/money So mak we dey very careful how we expose ourselves to people. Cos scammers go do anytin mak den win ur trust.