E get one of the politician wey talk, him say him no go waste him time for Nigeria issues because him no go fit dey talk to the deaf, so una see am this one no be time to carry government matter for head we sef we be our own problem forget the uncertainty wey dey our country.
I dey talk based on experience I get guy for where I dey work though me and am no too dey close, him salary na 15k this guy dey always complain say this money too small for him to take start life come still get savings as a man, all of us know say that one na true talk. So this my gee com play visual for sporty with 100 naira for our front this guy collect 200k with that happiness him say after that day him no dey work again carry the work hand over to him guy, the next day my guy go buy iphone x that one no pain me wetin pain me be say this guy dey already use iphone 7 after 1 month everything finish him come back to 15k work the same work wey no fit give am savings wey him talk, now tell me wetin iphone x Dom give am sometimes make we leave government use our sense wey God give us take over come challenges no use government as excuse so many of us for this forum Dom make this same mistake but the question na how many times u wan dey make this mistake, how many times u wan dey regret ur actions wisdom means alot apply wisdom while u still dey wait for government to do their own.